Cover Me Lyrics By Cobhams Asuquo ft. The Kabal,2Baba & Larry Gaaga

 


This post contains the official correct word for word lyrics of the song titled Cover Me By Cobhams Asuquo ft. The Kabal,2Baba & Larry Gaaga.


Read along to the correct word for word lyrics of this song,don’t forget to share your thoughts in the comment section below.





Cover Me Lyrics By Cobhams Asuquo ft. The Kabal, 2Baba & Larry Gaaga 


Ye Ye Ye Ye


I am just an ordinary paper chaser

Living my life I no get time for hater

Who go try try me

Let them see your face Jah

Over me


Cause since when dem born me

I never send faker

I no like bad people I dey smell danger

No evil eye try me

Let them see the great one

Over me


I no like to talk

I no like to shout

I just like to dey my own dey

Making my own pay

Move my hand to mouth

Without too much of effort

Because I get God

I wanna give the people music

Make dem lose it

Start to get up and dance

My vibe e dey pure

And I like to focus

On the things wey go make my life

And those around me their life to go up


I no dey smoke up

No be say I holy pass

But I know say dem no dey give award

For who dey smoke kpoli pass


So much on my mind I no fit shalaye

Sometimes make I no lie I want to trabaye

Some whiskey and some wine

To take the pain away

Everytime I lie awake

This is what I pray and say


I am just an ordinary paper chaser

Living my life I no get time for hater

Who go try try me

Let them see your face Jah

Over me


Cause since when dem born me

I never send hater

I no like bad people I dey smell danger

No evil eye find me

Let them see the great one

Over me


Oluwa cover me o-ver me o-ver me

From my enemy o-ver me o-ver me

I no get nobody o-ver me o-ver

Oluwa cover me o


Hmmm


Baba you know say

Me I’m just a simple hustler

Do things on a low

My mistakes are not irregular

Anything I do now make e be spectacular

Make your blessings shower me

Do it on a regular


As I no like to bother nobody

Make nobody bother me

If dem shoot dem arrow come my way

Use your feather cover me

Cause I no know dem but dem know me

Cause I wan love dem but dem show me

Dem criticize and victimise

And telling lies and show the signs

What dem owe me


So much on my mind I no fit shalaye

Sometimes make I no lie I want to trabaye

Some trophy and some kpoli

Take the pain away

Everytime I lay awake

This is what I pray and say


I am just an ordinary paper chaser

Living my life I no get time for hater

Who go try try me

Let them see your face Jah

Over me


Cause since when dem born me

I never send hater

I no like bad people I dey smell danger

No evil eye find me

Let them see the great one

Over me ehhh


Anybody wey try to dig pit for me

I jump am pass

And if dem want to get beef for me

E no go last

Anybody wey try to dig pit for me

I jump am pass, I jump am pass, jump am pass

Anybody wey try to dig pit for you

Jump am pass

And if dem try to set leg for you

Their own go cast

Ye Ye dem try to dig pit for you

Jump am pass ye ye

Jump am pass ye ye

Jump am pass


Oluwa cover me o-ver me o-ver me

From my enemy o-ver me o-ver me

I no get nobody o-ver me o-ver

Oluwa cover me o


Oluwa cover me o-ver me o-ver me

From my enemy o-ver me o-ver me

I no get nobody o-ver me o-ver

Oluwa cover me o



Song Written By:


Cobhams Asuquo

Innocent Idibia 

Comments