Paper Lyrics By Falz feat. Chillz



Paper Lyrics By Falz feat. Chillz


Dem say see danger oh

You no dey see danger oh

No go lose your center oh


All because of paper oh

Dem say see danger oh

You no dey see danger

No go lose your center oh

All because of paper oh


Yeah

Check!


All because you want to live the faaji life

You ready to pay the price

Do the sacrifice

You ready to pay the price

Take your mama life


And even you no fit explain this your appetite

You want the benz

You no wan take the taxify

You wan order gold bottles

Maybe 35


You wan halla private jet things

When you catch flight

Now you don dey shey weyrey lonso

You don dey bark for night


Skeleton is in your closet

You murder to chow suppper

All the wraps of powder

You swallow to pass border

All the person pikin you carry for tight corner


I see you when you collect

Ekun je Oga olokpa

Dem say you talk say you dey find raba

Na say you go and dip your two hands in foul matter


Oga this one you dey do

E pass arm robber

You turn criminal

Because you want to chow dollar


Dem say see danger oh

You no dey see danger oh

No go lose your center oh


All because of paper oh

Dem say see danger oh

You no dey see danger

No go lose your center oh

All because of paper oh


Yeah

Check

Ahh!


All because they offer you a little dollar

Na which kind foolish marriage wey you throw your daughter

Small girl pikin wey her hero still be Dora

Small pikin dem wey never suppose leave the mother


You need to hammer

You need to get the dough

E dey important

You want to chop national cake


You dey pray for contract

Dem give you Ghana must go

Make you change the number

Voting never start

You don dey say your congrats


Why your people no fit hide this long throat

No go use your dirty hand stain the white for my cloth

Mouth full of jokes

Hand full of notes


Oh I hear your people collect rice for some votes

Dem say you talk say you no like suffer

Na so you go and deep your two hands in our coffers


Oga this one you dey do e pass arm robber

Throway moral

Because you want to chow dollar


Dem say see danger oh

You no dey see danger oh

No go lose your center oh


All becasue of paper oh

Dem say see danger oh

You no dey see danger

No go lose your center oh


All because of paper oh ....

Comments