Talk Lyrics By Falz


Talk Lyrics By Falz


Anything I talk make you talk am again

Eh eh, talk am again


Anything I talk make you talk am again

Eh eh, talk am again


Brother Muric shout finish, we no see am for court

Eh eh, we no see am for court


Election don dey come, they go need your support

Eh eh, they go need your support


Since EFCC burst in, we no see you for club

Eh eh, we no see you for club

And you get legit work o, na wetin you talk

Eh eh, na wetin you talk


Na you talk am o

No be me talk am o

Na you talk am o

No be me talk am o

Na you talk am o

No be me talk am o

Na you talk am o

No be me talk am o


Four year tenure, three year holiday

Eh Eh, three year holiday

Our senator, don dey fight, Kung-fu again

Eh eh, fight Kung-fu again

Shey dem never tire, They wan continue the race


Eh eh, they wan continue the race

We buy your story, but you no give us change

Eh eh, you no give us change


Na you talk am o

No be me talk am o

Na you talk am o

No be me talk am o

Na you talk am o

No be me talk am o

Na you talk am o

No be me talk am o


Anything I talk make you talk am again

Eh eh, talk am again

Anything I talk make you talk am again

Eh eh, talk am again


Month don end, oga pay salary

Eh eh, oga pay salary

In 2019... 19,800 alawee? 

Eh eh, 19,800 alawee ....


Instead of may you work, you dey find Alhaji

Eh eh, she dey find Alhaji

You come turn your body to cash and carry

Eh eh, she don de cash and carry


Na you talk am o

No be me talk am o

Na you talk am o

No be me talk am o

Na you talk am o

No be me talk am o

Na you talk am o

No be me talk am o


Three private jet, you say you buy am for church

Eh eh, say you buy am for church

But your congregation no dey follow fly am of course


Eh eh, dem no dey follow fly am of course

Why your people still dey carry carry eye for someone

Eh eh, dem dey carry eye for someone


Shey I no be person

Cause no be your tribe I come from

Eh eh, Cause no be your tribe I come from


Small man thief for market

You set fire for em body

Big man thief money we dey hail am like dummy

We dey suffer, we dey smile

We dey fear to talk


My people no get chop, my people no get work

These days we no know if authority dey for office

Cause the yawa wey we see, no be security we you promise

And the cup e don full, we don tire for all the rubbish

All the punishment


Na me talk am o!!

Comments