Dem Mama Lyrics By Timaya



Dem Mama Lyrics By Timaya


I say they done come (iyo, iyo, iyo, iyo, iyo, iyo)

Nothing we do them (iyo, iyo, iyo, iyo, iyo, iyo)


Nigeria na my country oh

Bayelsa na my state oh

This na reality

Well e bin happen for Bayelsa oh

Nineteen ninety nine oh

I swear I no go forget am oh


When them kill the people oh

And they make the children them orphans oh

Any time wey I think am oh

Water dey pour from my eyes oh

Somebody say make I leave am oh

But I say me I must talk am oh


I say them don kill them mama eh eh eh

Them don kill them papa eh

I say them don kill them mama

Them papa them mama them papa them mama eh


I say they done kill them mama eh them papa eh ah

Them mama eh ah

Wetin we go do iyo

Do iyo

Say do iyo


Na so them march dey go iyo

Ten thousand soldiers for road iyo

Ask them where them dey go

Them say them dey go Bayelsa oh

Which place for Bayelsa

One village they call Odi oh


Na im them enter our village

And rape our young girls

And make us homeless oh (chai)


Them kill our mama iyo

Them kill our ppaa iyo

Them kill our brothers

Them kill our sisters

And make us homeless oh

Wetin we go do iyo

Do iyo

Say do iyo

Everybody dey cry oh

I say government them bad oh


I say them don kill them mama eh eh eh

Them don kill them papa eh

I say them don kill them mama

Them papa them mama them papa them mama eh

I say they done kill them mama eh them papa eh ah

Them mama eh ah

Wetin we go do iyo

Do iyo

Say do iyo


I don die oh

Poverty no good at all oh (chai)

Everyday for Nigeria

Na so the people them dey die oh

Eeeh, our government oh

Na why una make us dey cry oh

Ooh, everyday for Nigeria


Na so the people dem dey die oh

Them commot for house for morning oh

Money no dey for your hand oh

Police go stop you for road

Them go collect the one wey you get oh

Them lay allegation for your head oh

For wetin you no do iyo

Before you go know

My brother, you don dey inside cell ohh...

Comments