God You Are 2 Much Lyrics By Timaya


God You Are 2 Much Lyrics By Timaya


Olotu dan kpoda yehh


My God, you are too much yeh

God you are three much yeh

Thank you for talent yeh, chai

Timaya don explode yeh, chai

Olotu dan kpoda yeh

Gbarakuma gbarukuma dan kpoda yeh


Apart from music I no see wetin I for do, eh

Apart from music I no see wetin I for do, eh

Apart from sing I dey sing

I dey sing, I dey sing, I dey sing

Chai, apart from music

I no see wetin I for do, eh


Everybody say eyes up, everybody eyes up

Everybody make una mental because

Timaya music make una mental, yeh

Udunkulu eh, Timaya make you gbangbocha, eh

Egberi Papa gbangbocha eh

Everybody make una leave me eh, chai


Music too much for my body eh, chai

I no fit explain am

Everybody say, chai


Aboku, God you are too much yeh

God you are three much yeh

Thank you for talent yeh

Timaya don explode yeh

Olotu dan kpoda yeh

Gbarakuma gbarukuma dan kpoda eh


Well I say, I blow, I discover my talent, eh

When I was very, very young yeh

My mama say na school o, make I flow

Make I become a banker yeh

Dem wan me to take over my papa wetin e be yeh


Chai, well I try to dey go school

My brother, I no fit ye

Book e no enter my brain

My brother make e no be by force ye, chai


I decided to sing my song, my brother this na true story eh

Kay Solo my brother abeg make you tell them the story eh

Na when I went to Alaba, I go look for one marketer


Na so dem carry me play dem say my music e no follow at all yeh, chai

E no reach the Lagos standard

Now make una dey see me eh, chai


Every marketer na so them just dey follow me

Now them want to buy me

Everybody dem want to sell me

I say, "If not for Danco Music where I for dey, I dey"

If not for Wisdom Odogwu where I for dey today, chai


Dem don dey see me eh, everybody dey love me, eh

Make una just free me like my brother Terry G, chai

T.Joe na my friend o, ABHU Ventures na my paddy o

What about Obiano, Akin Jones

Everybody na my friend, eh


They want to buy my song

My brother na different collabo, chai

One collabo from another

Na different, different people, eh


Ekperi fada o

I say Timaya kpokada, o

And the thing wey I be today, o

My brother na chinekeme, eh

Chinekeme

Chinekeme

Chinekeme, chai

Terry G, let's go back to the club, chai, chai


My God, now you are too much yeh

God you are three much yeh

Thank you for talent yeh

Timaya don explode yeh

Eh, Olotu dan kpoda eh, kpaoda eh, kpoda eh

Gbarakuma gbarukuma dan kpoda, eh


Well, I sing say

Dem call me Timaya

Just because I'm getting higher

Na me be the Egberi Papa 1 of Bayelsa people, eh chai


Dem call me their tonyontonyon soldier, eh

Eh dem say, "I dey connected just like Turaya"

E no get wire

My guy, I no get to tire

Eh, everybody just look at me like say I be your attire, chai


Make una dey dance o

Everybody come feel me o

My music e too dey sweet for your ear


E be like say na juju o, no be juju o

Na Jehova God day do am o

Everybody make you dance and wine

And make you dance to the gbedu o


Eh, everybody kpoda eh, kpaoda eh, say kpoda eh

Everybody make una kpoda eh, kpaoda eh, chai

Comments